7 I nor fit sleep, I bi like bird wey only en dey on-top roof.
I don kry sotey my vois don krack and my neck don long like Ostrich own.
Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.
My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
Yu nor dey let mi sleep and I too dey weak to pray!