3 Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.
My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full, yet I neva forget to obey yor kommandment.
Make Yu nor rijet mi. Nor vex push yor savant komot from yor present, bikos na Yu dey diliver mi. So, make Yu nor leave or abandon mi, bikos na Yu dey fight for mi.
I dey die bikos pain and sadnes don make my years short. Sin don finish my strent and na die I dey die so.
Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.
But wiked pipol go die, bikos God enemies bi like flower for field wey go soon vanish like smoke.
and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.
E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.
E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.
but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.