22 wen ever dem and di difren kingdoms gada to woship God.
Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
Di whole eart go know God kon run go meet am. Evribody for di world go bow woship am.
Pipol wey dey guide di town, dey shaut as dem dey happy, bikos dem don si sey God dey kom back to Zion.
Jerusalem wey dem skata, make una shaut dey happy, bikos God go save en pipol kon give dem peace.
Before di world go end, my pipol go prish about God Kingdom go rish evriwhere.”
Yes! I go tok how Christ take do many mirakles and wonders thru di Holy Spirit pawa. I don prish di Good News from Jerusalem go rish Illyricum.