God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.
Israel God wey dey rule evribody sey, “Wen I don bring di pipol kom back to dia land, dem go tok for Judah sey, ‘Make God bless Jerusalem hill; di holy place wey E dey stay.’
Since wi dey wait for di day wey Christ go kom, make wi dey do wetin wi fit do to make Christ kwik kom. Bikos for dat day, evritin wey dey for heaven go burn kon skata and di stars, go melt.