4 So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.
Awa God, wi tank and praiz yor name wey get pawa.
Den David kommand en pipol, “Make una praiz di Oga wey bi una God!” And all di pipol praiz di Oga wey bi dia papa God kon bow honor en and di king.
And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem.
Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu, bikos yor pipol dey do wetin dem promise.
I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;
As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.
Make una sing and praiz God name. Evriday, make una tok about di good news sey, “E dey save en pipol.”
Make una give God di glory wey bi en own! Make una bring una ofrin as una dey enter en temple.
So, make wi praiz God great and wonderful name, bikos E dey holy!
Dem go dey happy, dey sing and shaut with joy till dem rish Jerusalem. Dem go dey happy forever and dem go dey free from sorrow and pain.
True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”