Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 100:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 100:2
15 Iomraidhean Croise  

For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.


King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.


King Hezekaya put priest and Levi pipol sey make dem dey burn sakrifice, serve, give ofrins, tank, praiz and dey woship God for en temple.


I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!


I go shaut for joy kon sing with praiz, bikos Yu don save mi


As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una.


Wen una dey celebrate dis feast, make una happy with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die, wey dey stay with una.


Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una,


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan