Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 10:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 10:9
28 Iomraidhean Croise  

wen dem hide for dia hold or just sleep dey wait for dia house?


bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.


So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”


Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.


Dem bi like lion wey dey hongry and dem nor fit wait to tear mi to pieces. Yes! Dem bi like yong lion wey hide for bush.


I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”


Wiked pipol dey use dia swod and bow take kill poor pipol, doz wey dem dey opress and doz wey dey raitious.


My God, si as dem dey wait for korna to katch mi; wiked and strong men dey wait to katch mi, even doh I nor sin or do bad tin.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.


Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear, na so too poor pipol nor fit fight wiked ruler.


Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money? Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.


Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.


To mi, E hide like bear or lion wey dey wait to attack pesin.


Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.


Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?


Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.


Babilon pipol dey hook and katch pipol like fish kon karry dem go for net as dem dey happy bikos of wetin dem katch.


Wen en sojas gada dey kom like strong breeze to kom skata and opress us, Yu kill dem with yor arrow.


Make una si as doz wey dey lead di pipol dey kry, bikos dia glory don vanish! Make una listin as lions dey shaut, bikos dem don distroy di bush where dem dey stay, near Jordan River!


Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.


So make yu nor allow dem deceive yu, bikos dem pass forty wey hide for bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anytin, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan