Time kon rish for David and en men to attack Jerusalem. Jebus pipol wey dey der, tink sey David nor go fit win di town. So dem tell David, “Yu nor go fit enter here, even blind pipol and cripple, go fit win yu.”
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.
So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.