Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.
Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.
Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.
Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.