Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 10:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Na God bi king forever and ever! Di pipol wey nor dey fear God, go vanish komot from dis world.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 10:16
20 Iomraidhean Croise  

Yu dey great and get pawa; Yu get glory, honor and respet. Evritin for heaven and eart, na yor own and dis na yor kingdom. Wi dey praiz Yu pass evritin for dis world.


bikos yor kingdom go dey forever and ever. Yu dey rule from one generashon go rish anoda.


So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God!


Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.


Yu make di nashons dey fear kon distroy wiked pipol, den Yu remove dia name from yor book forever.


E go judge di world well kon rule di pipol with betta mind.


God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.


God go reign forever and ever!


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one.


But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.


I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.


Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.


Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan