Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 10:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Why wiked pipol dey go free sef, even wen dem nor respet God? Dem dey sey, “God nor go ever ask us sey wetin wi do.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 10:13
13 Iomraidhean Croise  

Reuben kon tell dem, “I nor tell una sey make una nor sin against di boy, but una nor gri listin to mi? So naw, wi must pay for di sin wey wi kommit!”


If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.


Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”


For inside town, doz wey wound and di ones wey dey die, dey kry, but God nor dey ansa dem.


God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.


So God, na how long e go take before Yu go stop awa enemies wey dey curse us? Yu go let dem take yor name make yeye forever?


My God, si as di enemies dey curse Yu. Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name.


but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”


Jesus tell en disciples, “Anybody wey listin to una, don listin to mi and anybody wey rijet una, don rijet mi and God wey send mi.”


Make no man, woman, tribe or family among una leave di Oga una God kon go woship gods for oda kountries. Make nobody among una get any tree wey go bear fruit wey bitter or fit kill.


So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan