Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 10:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 10:11
13 Iomraidhean Croise  

Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us! Wi go dey free from trobol forever!”


But Oga God, dey laf dem. Yu dey laf all dis wiked nashons.


Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”


As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.


Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”


Dem sey, “God nor dey si us! Israel God nor even kare about wetin dey happen.”


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”


God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.


Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.


So some law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jesus tok for dia mind dey sey,


Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan