Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 1:6
17 Iomraidhean Croise  

Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold.


Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.


Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.


I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.


God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.


My enemies don die finish forever; di towns wey Yu rut komot from groun, dem nor go ever remember dem again.


Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye, but e dey lead am to en grave.


God nor like evritin wey wiked pipol dey do, but E love doz wey dey do good.


Oga God dey good, E dey protet en pipol wen dem dey trobol and E dey kare for doz wey trust am.


“Make yu pass di small gate enter, bikos di gate wey pipol go pass go sofa, wide well-well and many pipol dey waka enter.


“Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.


My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan