Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Proverbs 9:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wisdom don build en house with seven pilas.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Proverbs 9:1
17 Iomraidhean Croise  

Hiram put dis two bronze pila for where dem dey pass enter di temple. Di one wey dey di sout-side na, “Jakin”, while di one for nort na, “Boaz.”


Di Passage Hall long and wide rish 75 and 45 fit. E get korridor and pila and roof dey di korridor front.


Wisdom dey koll pipol for street and inside market,


My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu and nor ever forget wetin I sey make yu do.


Na wisdom pesin dey take build house, but na undastandin go make am stand


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


Make una hear mi! Wisdom dey koll pipol and undastandin wont make dem hear en vois.


God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!


And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.


so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”


so dat if I nor kwik kom, una go know how pipol suppose bihave for God church, wey bi di true pila and foundashon.


Anybody wey fit bear rish di end, I go make am pila for my Papa Temple and e nor go ever komot from der. I go rite my Papa name; David Town; di new Jerusalem wey dey kom from heaven and my own new name, put for en body.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan