Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Proverbs 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wen I still bi small boy for my papa house and as my mama only pikin,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Proverbs 4:3
8 Iomraidhean Croise  

David kon tink and sey, “Di temple wey Solomon wey bi my pikin go build, must fine well-well, but e still yong naw and e nor know anytin, so I must prepare tins for am.” So David gada many tins keep for Solomon before e die.


King David tell all di pipol, “Na Solomon my pikin God choose, but e still dey yong and e neva sabi many tins. Di work wey dem won do dey hard, bikos dis nor bi palis for man, but na temple for di Oga awa God.


Shimea, Shobab, Natan and Solomon na di sons wey dem born give David for Jerusalem and na Batsheba wey bi Ammiel pikin, bi dia mama.


My Oga God, wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini and dem nor get di pawa to know wetin go happen to dem.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan