3 If yu tell God make E bless evritin wey yu plan to do, yu go susid.
Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way.
“But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am.
So make una give all una trobol to God, bikos E kare about una. E nor go allow pipol wey dey obey am, draw fall for groun.
Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
Jesus tell en disciples, “Naw I dey tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for body.
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
Make una karry all una trobol give God, bikos E kare for una.