8 Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem.
Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.
Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace.
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.
Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins.
Good work dey bring gain, but yeye word dey kause poverty!
Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.
Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,
Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.