4 So Moses tell Israel pipol sey make dem dey do di Passova.
Den Moses gada di eldas for Israel kon tell dem, “Make all di family kill one yong sheep or goat take celebrate di Passova.
For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”
And dem kon do di Passova for di fourteent day for evening and na di first mont for Sinai Wildaness, just as God kommand Moses.