2 Israel pipol must do di Passova for di rite time.
Di king kommand di pipol, “Make una dey obey di Oga una God Passova, just as E dey dis kovenant book.”
Josaya celebrate God Passova for Jerusalem. Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di first mont.
Di pipol wey kom back from Babilon celebrate Passova for di fourteent day for di first mont.
For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God.
“ ‘For di fourteent day for di first mont, una go dey do di Passova Feast to tank God.
For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”
Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”
Di day for di Bread (wey nor get yist) Feast, wen dem dey kill sheep for sakrifice, kon rish.
Israel pipol stay for Gilgal and dem celebrate di Passova for Jeriko field for evening for di fourteent day for di mont.