18 Just as God kommand, Israel pipol go travel or stay one place and as long as di kloud still dey di Tabanako, dem nor go-go anywhere.
Israel pipol kon start to travel from Sin Wildaness, just as Oga God kommand dem. Dem stay for Refidim, but di pipol nor si wota to drink for der.
Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses.
Dis na how e always bi: Di kloud go kover am for day time and fire go kover am for nite.
Wen di kloud don stay for di Tabanako tey, Israel pipol go do evritin wey God kommand dem and dem nor go travel.
Wen di kloud dey for di Tabanako for some days, dem go dey dia kamp, just as God kommand dem.
My brodas, I wont make una remember wetin happen to awa papa dem wey follow Moses. God kloud protet dem as dem dey waka pass di Red Sea.
(Na wetin love mean bi dis: make wi dey do wetin God wont.) Na di kommandment bi dis and just as wi hear am from di biginnin; na so wi suppose to follow am.