12 Dem must nor leave any food till morning, or break any part for en bone; dem must do am akordin to di Passova law.
Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food.
Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone.
For dat same nite, dem go roast and chop di meat with bitter leaf and bread wey nor get yist.
God kloud dey-dey di Tabanako for day time and na fire e dey bi for nite and evribody for Israel dey si am as dem dey travel.
For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”
All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.”