Israel take en rite hand put am on-top Efraim head, even doh na en bi di yonga one. As e cross en hand, e kon put di left hand on-top Manasseh head, but na Manasseh bi first-born.
From among Israel pipol, I don give Levi pipol as gift to Aaron and en sons, so dat dem go do di work wey Israel pipol suppose do for di tent where dem for dey do meetin and dem go guide Israel pipol from di wahala wey go happen if dem go near di sanctuary.”