Dem karry am komot from Abinadab house for di hill kon go put am for one new truck wey melu dey draw. Uzza and Ahio, wey Abinadab born, na dem dey guide di truck.
Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.