Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Di one wey give en ofrin for di first day na Nahshon wey Amminadab born and na from Judah tribe e from kom.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 7:12
13 Iomraidhean Croise  

As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:


Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


Yu Judah, yor brodas go praiz yu. Yor hand go strong pass yor enemy own. Yor papa sons go bow down for yu.


Naw, di men wey go help una, na dia names bi dis: from Reuben tribe, Elizur wey Shedeur born; from Simeon tribe, Shelumiel wey bi Zurishaddai pikin; from Judah tribe, Nahshon wey bi Amminadab pikin; from Issakar tribe, Netanel wey Zuar born; from Zebulun tribe, Eliab wey bi Helon pikin; from Josef sons: from Efraim tribe, Elishama wey bi Ammihud pikin and from Manasseh tribe, dem pick Gamaliel wey Pedahzur bi en papa; from Benjamin tribe, Abidan wey Gideoni born; from Dan tribe, Ahiezer wey Ammishaddai born; from Asher tribe, Pagiel wey Okran bi en papa; from Gad tribe, Eliasaf wey Deuel born and from Naftali tribe, dem pick Ahira wey bi Enan pikin.”


Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem.


Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.


Bikos God tell Moses sey, “Dem must give dia ofrin to take dedikate di altar; one leader for each day.”


En ofrin na one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, but na akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;


Ram na Amminadab papa, Amminadab born Nashon, Nashon kon born Salmon,


Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.


and na Amminadab born Nahshon. Nahshon na Salmon papa


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan