Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 5:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 make God curse mi among di pipol. Make E nor give mi pikin again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 5:21
9 Iomraidhean Croise  

Yu go get sirious diziz wey go make yor intestine swell-up.”


join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.


Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever.


Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.


So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’


If di woman sleep with anoda man, di wota go gi-am betta pain; e nor go fit born again and na curse go follow am among di pipol.


As e hear dis one, Pita kon dey swear, “I nor know di man!” Dat same time, fawol kon make, “Kukuruku.”


For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”


Naw, di men for Israel don dey hongry, bikos Saul make dem swear sey: “E nor go betta for any man wey go chop food before evening! Make nobody chop anytin until I don revensh my enemies!” So nobody chop anytin


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan