Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 4:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Dem go take all di tools wey dem dey use for di Holy Place, wrap dem with blue klot; use fine leda take kover dem kon put dem for sometin wey dem go fit take karry dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 4:12
16 Iomraidhean Croise  

Some of dem dey keep di tins wey dem take dey woship God for di temple. Na dem dey bring and keep dem anytime wey dem use di tins finish.


Na dem dey keep di holy tins, flour, wine, olive oil, incense and spices.


Hiram make di pots, shovels and bowls. E finish all di work for God Temple, just as King Solomon tell am.


di pots, shovels and di meat fork. All di tins wey King Solomon give Hiram make e do for God Temple, dem make dem with bronze wey dem polish.


Solomon still make all dis fine tins for God Temple, di golden altar and di tabol wey e go put di sakrifice bread;


Na pure gold dem take make di wick iron, di bowl, spoon and di censer. Na gold dem still take make di door-mot, di house front, inside di door and di temple door.


ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood,


Yu must make am with all di tins wey dem go put inside, just as I show yu.”


di garment wey dem weave; di holy garment wey Aaron and en sons go wear to take serve as priest;


Dem go kare for evritin wey dey inside di tent and for Israel pipol.


“Dem go spread blue klot for di altar wey dem make with gold kon kover am with fine leda and di poles wey dem go take karry am, go dey inside.


“Dem go still remove di ashes wey dey di altar kon kover am with purpol klot.


Den dem go use fine leda take kover am kon spread blue klot on-top. Den, dem must put di poles wey dem go take karry am for inside.


“Make dem use blue klot kover di tabol wey God bread dey, di plate, di incense bowl, di ofrin bowl and di jar wey dem dey use for wine ofrin. Bread must always dey di tabol.


“Di lampstand, di lamps, di fork, tray and all di olive oil kontaina wey dey der, dem go kover am with blue klot.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan