I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do:
Dem fit still serve mi for di temple kon stand for di gate den do di temple work. Dem fit kill di animals wey pipol kom offa as sakrifice and dem must dey to serve di pipol.
Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.