Wen dem rish Eshkol Valley, dem kon kut one branches wey grape full and two men karry am with stik. Dem still take some pomegranate fruit and fig follow body.
Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.