5 So wi wont beg make una give us dis land as awa propaty. Make una nor make us cross Jordan River with una.”
Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road.
Joab bow for David kon sey, “My king, make God bless yu! Naw, I know sey yu dey happy with mi, bikos yu gri with wetin I tok.”
Wen di king si Estha for di gate, belle sweet am, den e stresh en gold rod and Estha kon go tosh di rod.
Doz wey still dey alive, I go sorry and favor dem wen dem dey desert. I go give Israel pipol peace for dia mind.
di land wey God don give Israel pipol dey good for kattle and yor savants get kattle.
Moses kon tell Gad and Reuben pipol sey, “Una won stay here make only una brodas go fight war?
And God sef still vex for mi, bikos of una. E tell mi sey, “Even yu, Moses nor go enter di land wey I promise una!
Joshua kon pray, “My Oga God! Wetin make Yu take us cross Jordan River kon give us to Amor pipol, so dat dem go distroy us?
Rut knee down face groun for Boaz front kon sey, “Wetin make yu dey good and kare for mi, even doh yu know sey I bi strenja?”
But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”