Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.)