Dis na wetin God tok about Moab pipol: “Betta wahala dey kom meet Nebo pipol, bikos dem don distroy and seize Kiriataim town. Dem don skata en strong wall kon make di pipol dey shame.
Pipol nor go praiz Moab again. Enemies don seize Heshbon land kon plan as dem go take distroy Moab town. Dem go distroy Madmen town too and na wiked sojas go mash kom skata am.
I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol. Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea den kon go Jazer town. But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin, don skata.
Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.
For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?