10 So God kon dey vex dat day and E swear sey,
So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”
So, I kon swear for dem di wildaness sey, I nor go take dem go di land wey I don promise dem; land wey dey okay, good and fine well-well.
Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present?
But I promise sey, as long as I dey,
Doz wey rijet mi nor go ever enter di land wey I promise dia grand-grand papa.
Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land.