Den dem tell Fero, “Wi just won stay for dis land for sometaim. Wi nor get food for awa animals, bikos of di honga for di whole Kanaan. So wi beg, make yu let wi yor savant stay for Goshen.”
Dem cross Jordan River go kamp for di sout-side for Aroer land, di town for di valley wey dey Gad aria centre. From der, dem go di nort side for Jazer and
Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop.
I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol. Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea den kon go Jazer town. But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin, don skata.
Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.
Gad pipol take di best land for diasef; dem give dem di leadership. Wen Israel pipol leaders don gada, na Gad pipol dey first obey God kommand and rules for Israel.”
So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.
bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.