But Levi pipol must keep all dia first-born wey bi man for mi! Na mi bi Oga God! Na mi get all di first pikin wey Levi pipol animal go born. So I go take Levi first sons and animals as my own kon leave di rest tribes.”
“Make yu take Levi pipol instead of all di first-born for Israel, den all di first-born wey Levi pipol animal go born, make yu give dem to mi, instead of all di first-born wey di whole Israel animal go born. Levi pipol go bi my own. Na mi bi Oga God.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.
Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.
Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.