32 Naw, di pesin wey dey lead all di leaders for Levi tribe, na Eleazar wey Priest Aaron born. So dem choose am to supavise doz wey dey work for di Holy Place.
Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.
“Di work wey dem give Aaron son, Eleazar, na di whole tent and di oil wey dey di lamps, di incense, di korn ofrin, di anointin oil and evry oda tin wey dey di tent wey dem don make holy for God.”
Dem fit help dia brodas for di work; dey give dem wetin dem wont, but make dem nor do any work. Dis na wetin yu go tell Levi pipol to do koncerning dia work for di sanctuary.”