29 Na dem go kare for di Holy Place. Kohat family go stay near di sout-side for di Tabanako.
But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”
For di sout, doz pipol wey dey under Reuben tribe, stay akordin to dia group and di pesin wey dey lead Reuben pipol, na Elizur wey en papa na Shedeur.
Gershon family go stay for di west side wey dey di Tabanako back yard.
Doz wey dem don kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 8,600.
Di pesin wey dey lead dem na Elizafan wey Uzziel born.