13 bikos all di first-born na my own. Wen I kill all di first-born for Egypt, I keep all di first pikin for Israel for mysef, so both man and animal na my own. Na mi bi Oga God.”
Wi go karry di first boy pikin wey awa wife born go meet di priest for di temple and dem go dedikate am give God, just as dem rite am for di law. Wi go still dedikate di first melu, sheep, lamb and goat wey awa animals go born.
Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’
Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house.
Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.
But Levi pipol must keep all dia first-born wey bi man for mi! Na mi bi Oga God! Na mi get all di first pikin wey Levi pipol animal go born. So I go take Levi first sons and animals as my own kon leave di rest tribes.”
di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.