Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 28:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Make una give di first lamb for morning and di sekond one for evening,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 28:4
12 Iomraidhean Croise  

Dem shaut and kry till aftanoon, but dem nor hear any sound, ansa or anytin.


Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.


Evry morning and evening, dem dey offa burnt sakrifice for di altar, just as dem rite am for God Law Book.


Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.


“ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals.


Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.


Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!


If una give sheep as ofrin, una must gi-am for God present.


Dis na di food ofrin wey una go give to God evriday: two man lamb wey bi one year and dem must dey okay.


each one with di korn ofrin wey bi one kilogram for flower, wey dem mix with one lita of di best olive oil.


For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan