4 Wetin go make awa papa name lost from en family, bikos e nor get man pikin? So make yu give us propaty from di ones wey awa papa family get.”
Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?
Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body, but wiked pipol lite go soon kwensh.
“Awa papa die inside wildaness, aldo e nor join Korah pipol and doz wey gada demsef against God; but e die bikos of en own sin.
So Moses take dia kase go meet God.
Di girls go meet Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and di leaders kon sey, “God tell Moses sey make e give us land among awa pipol.” So, Joshua give dem land among dia papa brodas, just as God kommand.