2 Dem stand before Moses, Eleazar di priest, di leaders and all di pipol wey gada for di tent where dem for dey do meetin door-mot kon sey,
and na Abishua wey Finehas born bi Bukki papa. Eleazar wey bi Aaron pikin, na-im bi Finehas papa.
Den di dotas wey Zelofehad wey Hefa born, wey Gilead born, wey Makir born, wey Manasseh born wey Josef born kon kom. Di girls names na, Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
E go stand before Eleazar wey go-go hear from God akordin to di Urim. Akordin to en kommand, dem go-go out and kom in, both en and all Israel pipol.”
“Awa papa die inside wildaness, aldo e nor join Korah pipol and doz wey gada demsef against God; but e die bikos of en own sin.
Doz wey dey lead Ramot tribe, wey Makir born and Manasseh wey Josef born, en grand-shidren kon go meet Moses and di oda leaders
Some pipol wey nor dey klean, bikos dem go tosh dead body, nor fit keep di Passova for dat day. So dem go meet Moses and Aaron