Nombas 26:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English5 Reuben na di first-born for Israel. Reuben shidren na: Hanok family, Pallu family, Faic an caibideil |
And dem bi: Israel first pikin Reuben akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia name. Di nomba for Reuben tribe na 46,500. From Simeon tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Simeon tribe na 59,300. From Gad tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Gad tribe na 45,650. From Judah tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Judah tribe na 74,600. From Issakar tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Issakar tribe na 54,400. From Zebulun tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Zebulun tribe na 57,400.