Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 24:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 di man wey dey hear wetin God dey tok. Pesin wey dey si vishon from God, even as en eye open. So e sey:

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 24:4
20 Iomraidhean Croise  

Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”


Wen nite rish, Abram kon sleep deep sleep, den fear kon dey katch am.


So Mikah kon ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, so make dem go dia house with peace.’ ”


Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king.


Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.


God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.


Dat nite God appear to Balaam kon tell am, “If dis men sey make yu follow dem, ready make yu follow dem, but na only wetin I tell yu, na-im yu go do.”


Den God open Balaam eye and e si God angel as e stand for di road with swod for en hand; so e kon fall face groun.


Den Balaam profesai sey: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;


‘Si as Israel tent fine, di place where Jakob dey stay!


afta sometaim, e kon dey hongry, but di food neva ready. As e dey wait, e kon si vishon.


As Pita still dey tink about di vishon, di Holy Spirit kon tell am, “Look! Three men dey find yu.


Wen I go Jerusalem back and dey pray for di temple, I kon si vishon


On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,


Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,


E even tear en klot komot from en body kon dey tell Samuel wetin go happen. E sleep naked for der from morning till di next day. Na dis tin make pipol dey ask weda, “Saul sef don bi profet?”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan