Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
Saul tell Kenite dem (Pipol wey dia grand-grand papa dey nice to Israel pipol) wey dey stay with Amalek pipol sey, “Make una komot from der, if not I go kill una join dis pipol!” So Ken pipol kon komot from der.