Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 23:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 23:1
19 Iomraidhean Croise  

May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”


Dem sakrifice seven bull and seven ram, bikos God dey help di Levi pipol wey karry di Kovenant Box.


Dem bring seven bulls, seven rams, seven lamb and seven goats to offa as sin ofrin for di kingdom, for God Temple and for Judah pipol. Di king tell di priest wey kom from Aaron family sey make e do sakrifice for God altar.


Naw, make una take seven ram and seven melu go give Job kon offa dem as sakrifice for unasef. Job go pray for una; den I go ansa una prayers and I nor go disgrace una again, bikos una nor tok di trut about mi just as Job tok.”


“ ‘Make una use mud build altar for mi kon sakrifice una animals and do peace ofrins for mi. Anywhere wey una for honor my name, I go kom meet and bless una for der.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.


For each of di seven days for di festival, e go sakrifice seven ram wey dey okay kon burn dem give God. Evriday, e go still sakrifice one goat as ofrin for sins.


Den di next morning, Balak kon take Balaam go Bamot Baal where e go for fit si some Israel pipol from far.


So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar.


Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.”


So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.


“ ‘For di sevent day, make una give seven melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.


Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan