Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 22:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 kon send messenjas go koll Balaam wey Beor born for Petor, wey dey near di river for en town sey, “Si, one nashon don komot from Egypt. Dem plenty well-well for di eart and dem dey stay klose to mi.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 22:5
15 Iomraidhean Croise  

And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem.


So God kon make Israel pipol plenty and dem kon too many for dia enemies to handle.


Di lokust kover di groun kon make am black, den chop all di plants and fruits wey dey for di tree wey di ice-blok distroy remain. No leaf remain for di tree and all di plants and grass, die finish for Egypt.


My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”


Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’


Dem kill di five kings for Midian wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba. Dem still kill Balaam wey Beor born.


Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una.


But di Oga una God nor gri listin to Balaam. Di curse wey Balaam suppose curse una, e turn am to blessing bikos di Oga una God love una.


Israel pipol kill Balaam (wey bi profet) wey Beor born.


King Balak wey Zippor born for Moab kon attack Israel. E koll Balaam, Beor son sey make e curse una.


Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan