Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Evribody for Israel must stay with en family; dem must stay near di tent where dem for dey do meetin.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 2:2
23 Iomraidhean Croise  

Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.” Na der dem for stand dia war flag.


So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!


Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”


Make evribody wey dey for di world, listin! Una go si one flag on-top di mountin, den una go hear one trumpet sound,


“Man pikin, na my throne bi dis. I go stay here with Israel pipol kon rule dem forever. Di pipol for Israel or dia kings nor go disgrace my name wey dey holy again or woship anoda god or dia king wey don die.


Wen dat day rish, just as shepad dey save en animals from danger, na so too Oga God go save en pipol. Dem go shine for en land like crown wey dem make with gold.


But make yu put Levi pipol to look, kare and dey near di Tabanako and evritin wey dey inside.


Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem.


Di next tribe wey follow na Reuben pipol and dem kon dey waka with dia flag. Na Elizur wey Shedeur born dey lead dem.


Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem.


Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem.


God kon tell Moses and Aaron:


For di sout, doz pipol wey dey under Reuben tribe, stay akordin to dia group and di pesin wey dey lead Reuben pipol, na Elizur wey en papa na Shedeur.


Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.


As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.


bikos God wont make dem do evritin well. Wen God pipol meet for church,


But make una dey do tins as e suppose to bi.


Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.


Dat pesin nor dey with Christ wey bi di head. Bikos na Christ join di whole body togeda, as dem dey grow inside God.


But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan