Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 2:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Di group for west na Efraim tribe. Di pesin wey dey lead dem na Elishama wey Ammihud born.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 2:18
13 Iomraidhean Croise  

Naw, koncerning yor two pikin wey yu born for Egypt before I kom here, dem go mi my own. Just as Efraim and Manasseh bi my own, na so Reuben and Simeon go bi my own too.


As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”


From Josef sons: From Efraim tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Efraim tribe na 40,500. From Manasseh tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Manasseh tribe na 32,200. From Benjamin tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Benjamin tribe na 35,400. From Dan tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Dan tribe na 62,700. From Asher tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Asher tribe na 41,500. From Naftali tribe: akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so, wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names. Di nomba for Naftali tribe na 53,400.


Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem.


Di pipol wey dey under Efraim tribe na 40,500.


For di sevent day, Elishama wey Ammihud born, wey dey lead Efraim pipol, kon give en ofrin.


and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elishama, wey Ammihud born, give.


Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan