Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu.
Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu.
Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.”