12 Israel pipol kon tell Moses, “Na die wi dey so!
Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.
Wen pesin distroy ensef with di stupid tins wey e do, e go kon blame God.
I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
So Moses do wetin God kommand am.
Na en get am and en shidren go bi priest forever, bikos e take en God sirious kon make mi forgive dis pipol.’ ”
But di sons wey Korah born, nor die.
Abi una don forget di advise wey God tell una as en shidren? “My pikin, make yu listin well-well wen God dey korrect yu and nor vex wen God ponish yu.