Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place.
But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.